Get all round Breaking news on entertainment, celebrities gist, music and lifestyle. Including movies and hilarious comedy clip.See latest updates!

Latest
Most Popular

Thursday 18 August 2016

"No Medal For Naija" : Nigerians Express Frustration At The Country Performance In Rio Olympics


Team Nigeria is yet to win a medal at 2016 Rio Olympic. Patrotic Nigerians back at home have started reacting towards the team performances.

Here is a post that was shared on facebook, it looks comical as you read but you can actually feel the frustration. See it below


"Small thing Ogoni man go jump enter water like
fish for days we no go see dem. See Olympics
nah, go swim,dem dey fear water . Zero medal
4 Naija
Hausa man go enter boat dey shout argungu
fishing festival. See rowing 4 Olympics, dem no
dey :]Y . Zero medal 4 Naija
Fulani herdsmen fit shoot arrow from 1km kill
anyone wey wan steal dem cow, Olympics reach
make dem go do archery, dem no sabi shoot
again . Zero medal 4 Naija
Igbo man go run from Sokoto to Aba at the
slightest provocation by Boko. See marathon 4
Olympics, dem no show face . Zero medal 4
Naija
Agbero for park no mind pursue bus for road. See
100metres race 4 Olympics, dem no sabi run
again . ZERO medal 4 Naija
Omo oni gala, CD sellers & other traffic hawker
nko? U go don reach Eko Idumota from Oshodi
thinking say u don carry their money go b4 dem
go appear for window say "oga na ur change bi
dis, wey di N200?" See 400 & 800metres race 4
Olympics, dem no sabi run again . ZERO
medal 4 Naija
Yoruba man go remove clothes, wrist watch and
pant to fight 4 Ojuelegba. See boxing 4
olympics,we no see dem :| . Zero medal 4 Naija
Na who even start that nonsense called NAIJA
GOT TALENT sef."
Share:

0 comments:

Post a Comment

Copyright 2015 Gistertainment. Powered by Blogger.

Find us Facebook

Subscribe Here

AFFORDABLE OFFERS AT JUMIA

Featured
Videos

Blog Archive

Definition List